diane

BBNaija Diane don act short film with Iyanya

BB Naija former house mate, Diane Yashim don do collabo with musician wey dem dey call Iyanya to act short film. The name of the film na the therapist.

Yashim na the person wey produce the film, she con share the trailer of the movie for her instagram page. The film na Evans Edeha naim direct am, Kenyan actress Lynn Nardia Bently act for the film too.

When Diane dey the big brother house she show her skills small for acting and she con talk say she get passion for acting when Akindele con visit the house mates. Like dis she don take her omomo step for the film industry.

Add a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *