Boko haram and oda bad groups don reduce finish as military dey use dem eye take dey see shege banza with di new style of teknologi.
Na wetin seketray to di Govomet of di Federation, George Akume tok wey some members of di Renewed Hope Fulbe Campaign Organisation come see am for he office on Wednesday for Abuja.
Yomi Odunuga wey be Akume media pesin nai even read wetin dey Akume mind give di Fulani pipo say di problem wey Nigeria dey no go tay as FG dey try hin best to stop am nai make am dey buy penti gun for sojas.
