+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Boys Don Turn Osubi Airport To Play Ground — Ovie Of Uvwie

Di Chairman of Urhobo Traditional Rulers Forum and Ovie of Uvwie Kingdom, His Majesty, Dr Emmanuel Sideso, Abe I, say boys don turn one side of Osubi airport to where dem take dey play ball.

Di king say make federal govimet use eye look di mata well so that di security of passengers go dey safe.

Na wey di king dey tok for hin palace wey Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo come for visit nai di king take say Osubi airport need upgrade to meet up with standard.

He say “ Honourable Minister of Aviation try your best to stop di way one side of Osubi Airport don be playground. Na big risk to passengers. We need world class airport.

“Wetin we want na total take over of Osubi Airport; make dem pay back salaries, di contract monie wey dey ground, make enough plane dey fly day and nite, make dem do new runway and expand am so that big plane fit land, then turn am to international standard.”

As so Omorkaro of Uvwie kinngdom, Keyamo come dey tok, hin say pressure dey he bodi and now wey he be member of di Federal Executive Council, Niger Delta go make sure say development touch ground for di region.

Nai he come say make di king nor worry as President Bola Tinubu go hear wetin hin complain and development go land di state sharply.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM