+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Saturday Election: Uzodimma Win Imo, Ododo Get Kogi, Diri Hold Bayelsa

Independent National Electoral Commission, INEC, for nite sat na Usman Ododo  All Progressives Congress, APC, nai win di govinorship election for Kogi State afta dem cancel some of di result wey dey for some polling units.

Ododo use 446,237 take win Murtala Ajaka of Social Democratic Party, SDP, as hin get 259,052 votes, while Dino Melaye, of Peoples Democratic Party, PDP come karey nuba tiree 46,362 votes.

Not be small bad mouth nai pipo take dey baff INEC since as pipo today some side for Kogi State na over voting nai happen there, but INEC nor resin dem bad mouth tok.

For Imo State wey di election still hold on Saturday, Govinor Hope Uzodimma of APC nai INEC declare winner, then di one for Bayelsa state na Govinor Douye Diri of PDP nai dey win with di result wey dem don calculate.

Dem dey wait for di result wey go come from Brass and Southern Ijaw and that one na for 12 today afternoon nai dem wan take calculate am.

For di result wey dem don calculate for Diri Bayelsa put of di eight local govimet Diri don use 64,106 vote take dey top, afta he score total 137,909 votes.

Put of di six LGAs wey INEC don put togeda na five nai Diri don hold then Timipre Sylva APC don win only one, nai be Nembe LGA.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM