+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Buy Chaka To Save Yoursef – Zamfara Rep Member Tell Hin Pipo

Afta bandits go hatak Bungudu Local Government for Zamfara state and tiff di LGA Chairman, Nura Abdullahi on Saturday morning, di House of Representatives member Hon. Abdulmalik Zubairu, wey pipo dey call Zannan Bungudu, don tell he constituency make dem go kolet dem moni for bank to buy chakabula to take protect demsef.

Wey di bandits hatak dem kill four security men, tiff Abdullahi, hin wife, children, and some oda family members karey dem enta bush.

Wey Zannan Bungudu come dey tok about di mata for DCL Hausa news station on Sunday he say “I don tell my pipo make dem go buy beta chaka even if na AK-47, AK-49. Make dem contribute moni, gada from anywhere take buy bets English.

“I say wetin i dey yarn nor folow Constitution, but to dey kpai innocent pipo too nor folow for Constitution. Qey two bad tin face you, you get to choose di one to save your life.”

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM