+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Chicago University Result: Atiku Wan Tok Of President Tinubu Result For Press Conference Today

With all di upandan wey dey happen for di academic records wey Chicago State University release about President Bola Tinubu give di presidential candidate of PDP, Atiku Abubakar, press conference dey come ontop di mata.

Statement wey dem release say na today for Yar’Adua Centre inside Abuja nai Atiku wan take do di press conference and make pipo come.

“Dis na to invite you come di World Press Conference of awa Presidential Candidate, His Excellency Atiku Abubakar, GCON, wey wan happen for Yar’Adua Centre, Today Thursday 5, October 2023, for afternoon.

“We never tok di time but we go soon tok am. Abeg make you come. Thank you.”

Atiku was get Tinubu academic records from Chicago State University through di epp of court for US.

With wetin dey for di records wey CSU release e show say di set of 1979 result wey Tinubu submit give INEC dey different from di ones wey dem give student that same year.

Even wey di CSU Registrar dey tok under oath, hin say he nor fit tok di kind certificate wey Tinubu give INEC.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM