+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Cholera For Cross Rivers Kill Teree Pesin

Two LGA wey be Obubura and Biase inside Cross Rivers State, Cholera don enta di place and now Govimet dey luk for how dem fit take stop am make up e nor spread every where.

Wetin Dr. Henry Ayuk di Cross Rivers State Commissioner of Health confirm he say na two pesin don die for Biase LGA while one die for Obubura.

He say di ministry sha don do Emergency Operation Centre with di Dr. Blessing Ekpenyong, wey be di State Epidemiologist and na she go dey as di manger wey go dey over luk any case wey dey for di process so that all tins fit go well.

“All di tins wey National Centre for Disease Control (NCDC) don donate plus mericin di Surveillance Unit and Logistic Management Coordinating Unit for Ministry of Health, dem go send am go all di ward wey di cholera don touch.

“We don already send LGA Rapid Response Team to di wards wey di cholera don reach to investigate di case and check di line so that e nor go too spread.”

Di commisoner come still tell pipo make dem hear all wetin dem don tell dem and make dem know which kind water to drink, nor dey eat fruits wey never ripe and food wey no gud.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM