+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Craze Man Wey Pastor Wan Deliver Don Finish Member With Cutlass

No be small gbege nai happen for one church wey dey for Obosi inside Idemili side for Anambra State on Sunday as one man wey e head set shake use cutlass take bucha one church member.

Na deliverance wey dem dey do for di kolo for di church nai di craze man take pick cutlass from di altar take cut anoda man wey dey di church.

With wetin Punch news tok from one man wey dey inside di church “Di man of God say he fit heal crazy man naso e start to pray. As e dey pray, di man come dey struggle with di pastor and di church members , nai e karey cutlas from di altar come use am take cut one of di members.

“Nai dem  karey di craze man go hospital for mad pipo, dem come rush di member wey e cut to hospital for treatment.”

Even di Police Command for Anambra State tru dem Public Relations Officer, DSP Tochukwu Ikenga, confirm say dem don karey di kolo go hospital for craze and dem don call e family pipo to ansa kwestun.

“Na on Sunday nai e take happen but dem don karey di man go hospital for treatment and e dey respond. With wetin we hear di man of God say e fit heal di craze and start to dey pray for am.

“As dem dey pray naso di kolo man start to dey drag with di pastor and other members wey dey inside, before e pick cutlass from di altar come use am cut one of di members.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM