+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Hold Dokitor For Throat Wey Rape 15 Years Girl

Di medical director wey be di oga kpatakpata of Optimal Cancer Care Foundation, Dokitor Olufemi Olaleye court for Ikeja Sexual Offences and Domestic Violence for Lagos don hold am for throat say hin really rape he wife sista pikin.

The judge of the court, Justice Rahman Oshodi nai be di court judge, he say all evidence from di small girl and di dokitor wey check her, just show kekereke say dokitor Olaleye really chop her clean mouth.

Di judge still say di messages wey di dokitor send go give he wife for WhatsApp and email dey beg hin wife to forgive am, still join for evidence.

Even sef statement and di undertaking wey dokitor Olayele write for Anthony Police Station join with di stamp from he lawyer, Olalekan Buruji, show says di man really rape di small girl cum force her to suck hin JohnThomas join.

As Court don luk all di mata wey clear like color tv for dem eye nai di judge stamp, back with he hammer say Olayele really rape di 15 years old small girl and he punishment na to face life imprisonment.

[Punch/SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM