+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Send Loyal Boys Of Gov Fubara To Prison

Federal High Court for Abuja don send five pipo wey dem hand dey for di fire wey burn Rivers State House of Assembly complex last year to prison.

Di pipo dem be loyal men of Govinor Simi Fubara their name na Chime Eguma Ezebalike, Prince Lukman Oladele, Kenneth Goodluck Kpasa, Osiga Donald and Ochueja Thankgod.

Na on Thursday nai dem karey di give of dem go meet Justice Bolaji Olajuwon, naso him say make dem go troway dem for Kuje prison until February 2 wey di court go give condition for dem bail.

For di seven count charge wey dey di five of dem head na terrorism of say dem enta where dem nor suppose to and burn down di Assembly complex with dynamites and other bad weapons.

Wey all di gbege dey happen for Port Harcourt last year, some Lawmakers even say dem must impeach Fubara before loyal boys of di govinor come fo put fire for di complex.

No be only burn of di complex dey di loyalists dem head as dem still kill one Superintendent of Police, Bako Agbashim, plus five police informant wey dey for Ahoada community.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM