+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Mr Ibu Son and Dauta Tiff N55m Wey Pipo Raise For Am– Police

Afta di wife, Mrs Stella Maris Okafor of popular Nollywood actor Mr John Okafor aka Mr Ibu go complain for police say her husband children and dauta dey tiff di actor moni, police don really see N50 wey dem tiff komot Ibu hakant.

Na detectives for Force Criminal Investigation Department Annex, Alagbion inside Ikoyi for Lagos nai open up for di mata how dem take catch Onyebuchi Okafor Mr Ibu son and hin babe wey be Jasmine Okekeagwu, di lady wey say she be adopted dauta.

According to di tokpesin of FCID, ASP Mayegun Aminat, di moni wey dem tiff so na di one wey world pipo gada gibe di actor make he use am pay for hospital bill.

Na di wife first dey manage di hakant but before you know nai Onyebuchi and Jasmine do di wife wayo, take di phone, comd hack di bank application app for di actor phone.

Afta dem don hack am nai dem delete am put am back for di phone and their own phone, na from there dem take tiff N55 million wire enta Onyebuchi hakant.

ASP Aminat say dem arrest Jasmine and Onyebuchi base on tiffing and wayo, and as hand touch dem N5 million don already waka from di moni.

Investigations come still show say messages wey Mr Ibu son and di Dauta dey send say dem don already do marriage for Ikoyi Registry and dey prepare dem visa wey dem wan take run go UK.

Di two of dem don land court, dem give dem bail of N15 million plus two surety wey get that kind moni.

Court karey di case to March 11th 2024.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM