The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say Naija record 198 new COVID-19 cases on Wednesday and dis one so don carry the total number of infections for the country go 66,805.
The number of people wen don legoo from d disease still dey for 1,169 unto say dem no record any death for the last 24 hours.
The 198 new cases wen dem report na from 13 states and d states nia be FCT (53), Lagos (48), Ogun (40), Akwa Ibom (20), Bauchi (9), Plateau (8), Kaduna (5), Kano (4), Benue (3), Jigawa (3), Nasarawa(3), Edo (1), Kwara (1).