+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police bullet nack three piple for Bayelsa

No be small matter nia play on Wednesday for the Edepie area of Yenagoa, Bayelsa State capital when one of the policemen wen dey on escort duty shoot anyhow and na so d bullet come hit one 17-year-old girl, one pastor wife and one trader wen dey for along the popular Tombia market area.

The road wen dey lead to the Edepie roundabout from the Tombia end na home to the popular Tombia market and motor parks and na so traders wen dey shade enter the road dey cause serious hold up for the people wen dey drive and even those wen dey waka wit leg no dey find am easy at all.

According to somebody wen dey there wen d matter take play, d go slow come hold the olokpa dem wen carry fash wen be about six in number, dem con come down from their motor and na so dem take start to dey shoot anyhow to clear the road so dat cars go fit pass.

Unto say the traders no gree comot from the road, one of the kpokpo dem come parasid and as dem fire gunshots na so d bullets come take hit the victims.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM