Commissioner of Police for Delta State, CP Abaniwonda Olufemi say he nor won hear any kind bad name of police for outside say dem dey do misbehave.
On Wednesday nai CP tok about di mata for statement wey Police Public Relations Officer, DSP Bright Edafe read.
All dis dey happen afta dem punish di DCO 2 of Abraka Division, SP Ibrahim Ishaku afta dem report case of 2.465,000 million.
Police oga kpatakpata say make di Abraka DPO with di DCO report demsef for dem headkwata.
As dem see say he hand really dey for di complain of misconduct nai dem sharply komot am so that he case go be lesson to others wey dey wan waka same road.
[SA]