+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dust and Thunder Go Dey From Thursday to Sunday – NiMet

Nigerian Meteorological Agency, NiMet, say apart from di heat wey dey di kontri update don come about serious dust wey go dey from Thursday till Sunday.

Di weather report wey NiMet bring on Wednesday for Abuja nai dem take say pipo nor go too see well for places especially for North side of di kontri.

Dem say small dust haze go dey for North Central and pipo for Kogi, Kwara and Benue go see di patch for dem cloud.

Places like Delta, Bayelsa , Lagos, Osun, Rivers Ondo and Ogun go see strong thunder for afternoon and evening time.

NiMet say e go beta make pipo use face mask as dust particles go dey fly for air every where and advise airline make dem get beta report about di weather before dem travel go anywhere.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM