+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Davido Pay Me N2.3bn And Beg Since You Nor Come Warri Again Show – Pinnick

Singer David Adeleke, aka Davido, mata don dey for court for as di organisers of Warri Again and Brown Hill Investment don say make di singer pay N2.3 billion as he go against dem contract.

Na Brownhill Investments Company Limited owner, Mr Amaju Pinnick nai file di suit through hin lawyer Kelechi Onwuegbuchulem, for Delta State High Court for Effurun.

Pinnick dey beg di court to give N2 billion general damage to Davido and hin record label.

Then Davido go pay N150m as legal and professional monie, ontop that he go come still pay N30 million wey he take file di case.

E nor stop there, Davido go come out for all he social media handle to beg Pinnick and still put for two newspapers for four days say hin dey sorry for wetin happen.

Di statement say n for Abuja airport nai Davido take see Pinnick, hin come waka meet am say he go like perform for di 19th edition of Warri Again wey go happen for October 6, 2023, dem come pay Davido N70m but he nor show face for di event.

All di time wey dem dey call Davido as di program don start, him and he record label nor pick, nai make Pinnick company say Davido must pay di full $94,500 wey dem pay give am as he nor gree come perform.

[Punch/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM