+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DSS Arrest APC Chieftain Wey Wan Cause Kasala For Kano

Di APC chieftain,  Abdulmajid Danbilki Kwamanda for Kano State wey dey waka about dey spread news for radio say he nor dey happy with di jorjimet wey court give about di govinorship election, DSS don arrest am.

Kwamanda nack chest say he must to make di state tire Govinor Abba Yusuf of NNPP make e nor fit rule.

For video wey Kwamanda do interview for one radio station, the video which has now gone viral, he say he go gada pipo make dem enta street dey cause wahala till FG go declare state of emergency for Kano.

As DSS see di video nai dem go arrest Kwamanda, karey am go give police, naso dem karey am go magistrate court.

Nai court send am to go karey e action inside prison.

Before DSS even catch am, Kwamanda don lie say di leader of New Nigeria People’s Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, don already conclude to bring back Muhammadu Sanusi, di 14th Emir of Kano wey dem bin porchu.

Di APC leader say hin blame President Bola Tinubu for wetin happen for di state, cus e for make sure say APC nor komot from power.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM