+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DSS Arrest Miyetti Allah Leader For Nasarawa

Department of State Service, DSS, don arrest di president of Miyetti Allah Kautal Hore, Bello Bodejo, cus he go form one vigilante group for Nasarawa State.

Na around 3:40 pm on Tuesday for dem Miyetti Allah head office wey dey close to Goshen churchn nai dem take go arrest am.

DSS and some sojas just show for Tundun Maliya Cattle Market Kilometre 22, Abuja-Keffi Expressway for Tundun-Wada inside Karu Local Government Area for Nasarawa State where di office dey, to catch Bodejo.

As dem zoom Bodejo for di gate naso DSS and sojas arrest am dump for dem motor, nai be off.

But di table dey shake one kind as DSS and Army say dem nor arrest Bodejo cus of di vigilante group wey he form.

But wetin di National Seketary of Miyetti Allah Kautal Hore, Saleh Al-Hassan tok be say, na DSS and soja naj arrest dem president.

To change mouth again, one insider from DSS confirm to Punch say na cus of di Nomad vigilante group wey Badejo form nai make dem arrest am cus di group fit come turn to anoda kasala case for di nation.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM