+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DSS Free Foma CBN Govinor Give EFCC

Godwin Emefiele wey be di foma govinor of Central Bank of Nigeria, Godwin Emefiele Department of State Services (DSS), don free am from dem custody.

Na one pesin wey nor gree call name nai tell The  Cable say DSS don free Emefiele but as hin dey come outside naso was taken into custody by the Economic and Financial Crimes Commission, (EFCC), dey karey am enta dem own custody to gibe am kwestun and ansa.

Na since June nai Emefiele dey for DSS hand afta  President Bola Tinubu give am suspension letter make he nor be di govinor for CBN again.

Wey dem take Emefiele to court, na two charges dey hin head say hin get guns without permission.

That one govimet come drop that charge but bring fresh 20 charges against Emefiele and hin sef dey beg make dem settle di mata outside court.

[The Cable/SA]

 

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM