+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DStv Don Gree To Show AFCON For SuperSport

Multichoice company wey get DStv say dem go show di African Cup of Nations games wey go start di weekend for Cote d’Ivoire.

Di first time Multichoice first dey vex say CAF go karey di right to show di tournament give French media power house, Next World.

Na di vex come make DStv say dem nor go gree show di game for dem SuperSport channels.

But as di South African company luk di mata from upandan nai dem change mind say dem go show di game.

Tori pesin Osasu Obayiuwuna say later today DStv go announce to everybodi to know say dem go show di AFCON game for SuperSport channel.

Before DStv dey gree say dem go show di game, Nigeria Television Authority (NTA) don already enta agreement with AfroSports to show di game live.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM