+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rivers State Chief Of Staff Don Resign

Commissioner for Information and Communications, Joseph Johnson, say Chidi Amadi don drop letter say hin nor dey work with Govinor Fubara again.

Before Chidi Amadi drop letter hin nai be di Chief of Staff to Rivers Govimet.

According to wetin Johnson tok he say Govinor Fubara go soon announce who go take over from Amadi wey be loyal pesin to foma Govinor Nyesom Wike.

He say, “Di foma Chief of Staff, Hon Chidi Amadi, don resign. Govinor go so tok who go take over from am wey di time reach.

“Na di govinor know when he go like put pesin. He go tell us then wey go announce am and you too go hear am from us.”

Wey tori pesin dey try dem best to call Amadi to hear from am even with WhatsApp message, e nor still ansa.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM