+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Youths For North Burn Nigeria Flag, Say Hunger Make Pipo Dey Chop Leave

Tension dey rise for everywhere if nor be nurses, e go be market women, or even Labour union.

Some youth for North don karey di same anger take go burn di Nigeria flag cus of di way price of food and other tins dey increase for di kontri under di new administration.

Di young boys for video wey dem share for X just dey provoke say dem vote President Bola Tinubu but wetin dem dey see today nor be wetin dem bargain cus na leaves nai some pipo dey eat why di big man dey swim for moni.

Dem say packet of Spaghetti na 700h dem dey sell now and e even gud as Nigeria nor win di match between dem and Cote d’Ivoire cus that one go make everybodi forget say hunger dey.

“We thank God say we nor win di match. We pray make Nigeria nor ever win anytin, if na so dem wan take rule us. We don tire for everytin.” Na so di young guys for North tok.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM