+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Don Get New Chairman And Seketary

President Tinubu don approve di appointment of Ola Olukoyede as di new Executive Chairman of Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

Olukoyede wey be pastor for redeem church, na still lawyer wey get over twenty years experience.

Hin go serve for four years as di agency chairman afta Senate don confirm am.

Mr Olukoyede new position dey come afta Presido suspend and pursue Abdulrasheed Bawa as chairman cus dem say he dey use di office take dey oppress pipo.

Then Muhammad Hassan Hammajoda nai dem come appoint as di seketary of EFCC and hin go dey di position for five years.

[Punch/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM