+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Go Hear Case From Court Today If To Arrest Yahaya Bello

Di way di case of arrest dey bi like say e dey turn eye for di arrest wey EFCC suppose arrest foma givinor of Kogi State, Yahaya Bello, court go decide am today.

One High Court for Kogi State, under Justice Isa Abdullahi don bin give order to EFCC say make dem nor arrest Bello cus of di N80.2 billion fraud case but that same day nai Federal High Court for Abuja under Justice Emeka Nwite say make EFCC go arrest Bello.

As EFCC get di order nai dem enta road to Bello hass for Abuja but bifor dem know di foma givinor don run leave dem say di Kogi High Court give order make nor bodi catch am.

Afta all di upandan some chieftain for APC don dey call govinors but di ones wey dey now and di ones wey don komot, make dem epp so that EFCC nor go just karey arrest Bello.

Wey the chairman of Tinubu Media Support Group (TMSG), Barrister Jesutega Onokpasa, dey tok on behalf of APC party leader, he say wetin dey hapun just dey go against di court of law order.

Even anoda group wey dem be Ebiraland Youths Coalition don dey tell Federal Govimet make dem make sure say notin hapun to Bello.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM