+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Never Call Us Tiff – Dangote Group

Afta di surprise visit wey Economic and Financial Crimes Commission, EFCC,  for do for Dangote company headkwata for January 4, 2024, di  company say dem ready stand with EFCC to epp with investigation.

Di group say dem go give any information to EFCC wey go epp dem  for di investigation of how dem take use foreign moni.wey dem kolet from CBN.

Na for December 6 last year nai Dangote say dem take get di letter from EFCC.

Di letter say make di company show paper of all di foreign moni wey dem don dey kolet from CBN since 2014.

Di company sha say dem bin don first send di first batch of documents go give EFCC but dem still send dem officers come di headkwata.

According to Dangote EFCC never point wrong finger to any of di company wey dey inside di group.

You go remember say foma CBN govinor, Godwin Emefiele wey enta for 2014 na last year nai dem remove am as govinor come troway am for prison

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM