+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Free Rail Travel Still Dey Till Jan 7, NRC

Di free transport wey Federal Govimet put for rail way, dem don shift am to front so that pipo go still enjoy am.

Na Nigerian Railway Corporation, NRC, nai tok so for dem website on Thursday.

NRC say na on di 7th of January nai di free ride for train travel go expire instead of di 4th of January 2024 wey dem first put.

As dem don make dis change, all di pipo wey dey wan travel with train and don book dem e-ticket make dem ready to travel free for di next teree days.

“Dear Passengers, we happy to tell you say train service go dey free from December 21, 2023, to January 7, 2024, with wetin President Bola Ahmed Tinubu don tok.

“We dey wish you Happy Christmas and Happy New Year!.”

Remember say for December nai President Tinubu reduce transport fare for road then he come do free ride for train travel till January 4 2024.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM