+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC See N3b For Foma Aviation Minister Broda Hakant

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don catch Abubakar Ahmad Sirika, broda of di foma Minister of Aviation wey just komot from position, Minister Hadi Sirika, say di broda play wayo for contract with Federal Ministry of Aviation wey cost N8.06 billion.

Di foma Minister karey contact give hin level 16 officer broda, wey EFCC come now trace N3.2 billion go Engirios Nigeria Limited, wey Abubakar Sirika deputy director for Federal Ministry of Water Resources get.

Di agency get to know say na four huge contract nai dem give Abubakar’s Engirios Nigeria Limited wey he broda na be di of  di ministry.

Di four contract wey di foma minister give him broda na to build Terminal for Kastina Airport for N1.3bn, to do maintain Fire truck and change di center for Kastina Airport that ine na N3.8bn.

Then make he use N615m take buy and put elevators, AC, and power generator hass for di Aviation hass wey dey for Abuja, buy Magnus Aircraft and simulator for Nigeria Aviation Technology for Zaria, for N2.3bn.

For all di contract wey di Minister give him broda, he nor do anyone but chop moni and clean mouth.

Wetin EFCC tok say dem investigation show say Abubakar Ahmad Sirika nai be di MD/CEO of di company and na only him get right to sign signature for di banks wey di company get.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM