+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Wahala Dey As Dakar Cut Phone Internet

Senegal Dakar don cut di kontri browsing network since 9:00 for morning cus opposition group sag dem wan gad for di front of di National Assembly.

Di resin be say di National Assembly never tok anyin about the proposal wey Senegalese Democratic Party bring come about why dem karey di presidential election go front.

As dem wan start di electoral campaign for Senegal on Saturday, February 3rd, e nor tay nai President Macky Sall just announce say dem don shift di election go front without any new date.

Normally di election suppose be February 25 dis year but as president of Senegal don shift am e come dey make pipo tension high naiem dem cut phone internet so that tori wey go fly nor go make every where too hot.

As opposition dem see di move naim dem call for rally and di way di govimet dey go now about di internet wey dem cut, just dey worse tins for di kontri politics.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM