+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Even For Grave I Nor Fit Forgive Mohbad, Naira Marley Crew

One padi of Afeez Fashola aka Naira Marley don say he hate Oladimeji Aloba, aka Mohbad wey don die, that even for death he still hate am.

Na for Instagram nai Law_lee101 take write say he nor like Mohbad and even as he don die he even still hate am wella.

Di tok don go viral sotay pipo come dey wonder why Naira Marley pesin go hate pesin wey don die like that, say that one na to show say dem nor really want make Mohbad dey alive bifor.

Naira Marley pesin say na cus of di way wey Mohbad and singer Zinoleesky take get problem, di late singer come tok about am online.

He say na di yeye tok wey Mohbad go tok about Zinoleesky nai make singer Portable get di write to dey tok to Zino anyhow.

Law_lee101 say if Mohbad not karey mouth tok, Portable for not get di face to take look down on Zino for event wey dem go.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM