+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Close Supermarket For Abuja Cus Of High Price, Soon To Enta Other Cities

Federal Govimet di Federal Competition and Consumer Protection Commission on Thursday say dem don enta some stores for Abuja to go check prices of wetin pipo dey sell.

Bifor now, FCCPC don dey tell market pipo to reduce di price of wetin dem dey sell since di price of dollar and naira don come.

To make sure say pipo folow up for di warning nai di Executive Seketray of FCCPC, Dr Adamu Abdullahi, send some of him workers to go check some supermarket for inside FCT, Abuja.

Na there dem notice say two of 4U supermarkets get fake 33 bags of Caprice and Stallion rice wey don already get weevils inside nai dem close di supermarket.

Abdullahi say dis one na di starting as dem go dey bust enta pipo store for major cities like, Port Harcourt, Lagos, Kano, Kaduna and other places to make sure say traders sell their goods for normal price.

Dem say today Friday na to busy enta pipo wey dey sell tins like tomatoes, leaf, fish, pepper and di rest and if di price dey very high, di sellers go dance to di music.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM