+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG dey sign bill while senate dey reject new bill

President Muhammadu Buhari don sign the N10.59 trillion 2020 appropriation bill enter law.

Oga presido sign the budget when d senate increase by N260 billion from d N10.33 trillion wen dey for the proposal wen oga Buhari submit on October 8th enter law yesterday for Abuja.

Meanwhile, this one na the fastest time since Naija return to democracy for d year 1999 wen d dem go submit, pass and den sign d budget before the budget year start.

Meanwhile

The house of representatives don bounce one bill wen dey seek to provide single term of six years for the president and governors.

The house reject d bill wen John Dyegh from Benue state sponsor after dem raise am up for second reading for their yesterday meeting.

During d debate concerning the bill, most of the lawmakers say dem no support am say becos nothing dey wrong with the system wen Naija dey currently dey operate.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM