+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Don Pause High WACE Exam Fee

Afta plenty tok hagais di high moni wey West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) and National Examinations Council (NECO) Senior School Certificate Examination (SSCE), go dey pay, federal govimet don pause am.

Na di ministry tok for letter on June 18th say na N50k nai WACE and NECO student go dey pay anytime dem wan write exam but toei come change on Monday as di Director of Press and Public Relations for Federal Ministry of Education, Boriowo Folasade, say dem don kolet di letter back.

Dem say tins hard teach di exam bodi side sotay printing, logistics and odas dey wan tear dem down but dem get to sitdon tok with oda stakeholders to see way forward and even di Minister of Education, Dr. Maruf Tunji Alausa, CON, don say make dem pause evrytin and folow wetin federal government tok.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM