+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fire Burn Shopping Mall For Gwarinpa Abuja

Fire don burn one popular shopping center for Gwarinpa inside Abuja on Wednesday

Na one pesin wey hin handle na @Mister_Mash for X nai share video of di fire wey dey burn di top of IC World Emporia Centre building.

Di user say di fire start around 4:13 for early morning as e see am nai he call @Fedfireng emergency line 0803 200 3557 but di woman wey pick just cut di call.

He say nai he come call 112 but dem tell am to call 122, he say afta he call di 122 nai d send am back to call 112.

Pipo for social media come start to dey share di video of di building wey dey burn before Nigeria fire service pipo come go off di fire.

Dis Abuja mall wey catch fire dey happen just few hours afta explosion happen for Ibadan wey kill 2 pesin, injure many and destroy property yesterday.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM