+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Foma NUPENG Gen Secretary, Frank Kokori Don Die

Foma general seketary of Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers, NUPENG, Chief Frank Kokori don die.

Kokori die for di age of 80 years, for early morning today for one hospital wey dem take dey treat and for kidney sickness for Warri.

N one of hin media aides nai confimate di news but say e nor wan shout am as di family nai get right to make pipo know.

“He don die for nite. I like make only di family use mouth take tell tori pipo.

“Na just aide I be but as e be I nor get right to tok much about anytin until di family bring state come outside,” di aide.

Dem say na on Monday nai di way Kokori dey feel come worst nai dem rush am put for life support.

For November nai di foma foma seke come out to cry say tins get as he be as he nor fit fly abroad to treat hinsef and na him dey even buy fuel put for di hospital generator so that dem fit on Ac for am.

Kokori that time dey complain di way dem take abandon am for one side afta all di sacrifice wey he don do for di kontri.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM