+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tins Go Dear For Market As Cargo Price Reach N952/$

Exchange rate for any cargo wey dem wan clear from sea federal govimet don use Central Bank of Nigeria to take increase di price from N783 per dollar to N952 per dollar.

Na only three weeks ago nai govimet karey di price from di N757 wey e dey per dollar to N783 per dollar, before dem dey add anoda moni put on top again.

Wetin tori even drop be say, di new price don already dey show for Nigeria Customs Service portal.

As dis new price don enta for sea clearance, nai be say price of tins don ready to rise like garri wey dem soak for water base on say most of di tins wey Nigeria dey buy na from outside.

Shege banza don dey ready to show many pipo cause pipo wey dey import goods from sea go come dey pay big moni for import duty tariffs.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM