Foma pawa Minister, Saleh Mamman wey court give rope with 16 count charges ontop money lundering of over N33.8 billion afta EFCC karey he kase to court, dem don move am to Kuje prison.
Court fess nack Mamman 75years to prison on May 13 but he nor come court afta dem give di jorjimet nai he run from Abuja to Kaduna with taxi but on Tuesday EFCC katch am go court.
NaiJustice James Omotosho of Federal High Court come read kase wey dey Mamman head of how he buy big properties with govimet moni and divert moni wey dem suppose use take do major light work plus di one for Zungeru and Mambilla hydroelectric project, bifor dem bundle am to Kuje prison.
EFCC come say dem even tell di court sat di five properties wey di foma Minsiter get for Abuja and Kaduna dem go sieze am as na govimet moni he take dey bugga since.
