+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Free Di Women Wey Lead Food Protest For Niger, Sowore Tell Police

Presidential candidate of African Action Congress, AAC, Omoyele Sowore, say make police sharply free di women wey lead di food protest for Niger State.

Resin wey make Sowore say make dem free di women na afta gist come on Wednesday say police don arrest Aisha Jibrin and di other pipo wey folow her.

On Monday some women and other pipo enta road for Minna Niger State dey cry say dem nor fit buy food eat again as everytin don hard.

Di arrest of Aisha and di rest make Sowore vex wella sotay him come enta X dey provoke tell di command force for di state make dem free di women.

“I just hear say di women wey dey front for di protest cus of di way price of food for Niger State take dey go up, police arrest dem.

“Police fast free that woman cus many other women dey back dey come with di way tins dey go,” wetin Sowore write.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM