Di senior envoy to South Africa nai Ghana Foreign Affairs Ministry don call to come ansa wgile dem go dey behave anyhow to dem Ghana men wey dey stay for South Africa.
Di mata start from one video wey some group dey ask one Ghana man wetin he dey do for South Africa, say dem nor want am, make di man go back to Ghana and epp he kontri as dem dey porchu any pesin wey be black.
Ghanaian officials sha don meet with di man for di video, say dem go give am epp and di man sef nor dey use wayo take stay for Southy but di officials tell am make he dey law abiding.
Di Ministry still meet South Africa acting High Commissioner to Ghana, Thando Dalamba, come tell am say di protest wey South Africa dey do hagains pipo wey nor come from South Africa nor make sense and na wetin go cus big problem if dem nor treat am well.
