+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Glo Line Nor Go Fit Call MTN Line Again – NCC

Pipo wey get Glo line for nor dey call MTN line again if dem nor settle di interconnect charges wey dem dey owe.

Na Nigerian Communications Commission on  Monday nai write public notice wey di Director for Public Affairs Department, Reuben Muoka sign, nai dem take tok so.

E say di commission don gree small make dem cut Globacom from MTN Nigeria Communications Plc.

Part of wetin di notice tok be say, “We don tell Globacom di notice wey MTN bring and dem nor get right to tok anytin.

“Afta di Commission don luk di gbese, nai dem  gree say dem nor get any beta resin not to pay di interconnect charges.

“NCC don gree say afta 10 days finish from di day wey dem bring dis notice, pipo wey dey use Glo nor go fit call MTN but dem fit get call from MTN.

“Di time wey dem go cut di line call, e go allow calls to enta Globacom network.”

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM