+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Breakfast Don Reach FCCPC and BPE Ogas

President Bola Tinubu don sack Babatunde Irukera di Chief Executive Officer of di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) and Alexander Okoh wey be Bureau of Public Enterprises (BPE) oga.

Na Ajuri Ngelale nai President Tinubu take send di sack go give dem on Monday.

Say di resin wey make dem give dem breakfast for dis new year na make dem fit luk di govimet agency well and reposition am.

And dis breakfast wey Presido give di two ogas na with sharp komotin, say make dem karey all govimet property give di next pesin wey dey follow dem for office.

Na close eye open am nai President Tinubu take give FCCPC and BPE oga to take komot from di agenciea wey dem dey.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM