+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gov Sanwo-Olu Open $100m Film City Project For Lagos

Govinor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State don open one $100 million film city project for Lagos wey one private-public partnership company go handle.

Di name of di film city na Kebulania and na for Ejinrin town inside Epe LGA nai e dey, and na colabo with Del-York International Group nai wan run di package for Lagos.

Wey dem dey open di place yesterday for Epe nai  Sanwo-Olu say dis one wey be di first film city for Lagos, wen go epp to bring pipo talent come out ans work go dey then pipo go even like to come put dem monie as investment.

Di govinor say di ciltu na where dem go take dey produce film, afta production, visual effect, and all di tins wey go support film making nai go dey happen for di city.

He say “Wetin we dey resin na city wey get beta tins like sound stages, editing suites, production offices, and anytin wey you fit think to make magic dey for your screen.

Na Linus Idahosa, CEO and Founder of Del-York Group nai born di plan three years ago

Wey Idahosa come dey tok for di event he say di idea na to unlock di creative tins wey dey di state and he pray say Lagos Film City and Lagos State Ministry of Tourism, Arts and Culture go get beta upliftment from di project wey go turn our to epp di state.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM