+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gov Seyi Makinde Tok How Fake Miners Cause Explosion For Ibadan On Tuesday Nite

Di explosion wey happen on Tuesday night for Ibadan, Oyo State capital, Govinor Seyi Makinde don give update say na from illegal miners wey dey di state nai cause am.

Makinde say di small investigation wey dem don do nai show say di explosion so come from one of di houses of di fake miners wey dey keep explosive tins for inside dem house.

For statement wey di govinor bring afta e go luk di site wey e take happen and different hospitals wey pipo wey wound dey, nai e take say two pipo die then  77 dey for govimet and private hospital.

Govinor Makinde come still post press briefing for he X handle, say dem go pay di hospital bill of di pipo for hospital and afta investigation dem go punish di pipo wey dem hand dey for di explosion.

“Di small investigations wey security agencies don do show na from illegal miners wey dey for stay for one of di hass for Bodija nai cause di blast wey kill and injure many pipo join with property.

“Dokitor pipo dey for standby. We don go UCH to see some of dem wey injure. Di total na 77 but dem treat many of dem and discharge too, na 2 pesin nai die. We pray God to epp di family dis period.”

Na on Tuesday nite around 7:30 nai pipo wey dey stay for Ibadan just hear wan big sound wey shake everywhere. Dem tok say many pipo die join with property wey destroy.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM