+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Herder’s nai attack me-Samuel Ortom

 

…. we no support Ortom attack-NGF

…. IGP don order police to investigate the mata

…. we no go release land for open grazing-Ortom

 

The Northern Governors Forum,NGF don talk say dem no support d the attack wen bad guys attack the convoy of Samuel Ortom, d governor of Benue state.

Wen Simon Lalong, chairmo of the forum and governor of Plateau state dey yarn on top d matter, he come talk say the matter get d way e be say dem need to do thorough investigation on top d matter.

The matter na say some bad guys attack Ortom convoy on Saturday for Tyo-Mu community near Makurdi.

Whereas on top dis same matter, Mohammed Adamu wen be d inspector-general of police (IGP) don order investigation concerning the attack wen bad guys attack the convoy of Samuel Ortom, d governor of Benue state.

Wen Orton dey talk wetin really happen, he come talk say d guys wen carry fash wen attack am na “herders”, say na him security aides wen stand fit nia chase dem.

Then wen Frank Mba, talk talk person of the Nigeria police force dey voice for inside one statement on Sunday, he come talk say the inspector-general of police don direct the commissioner of police for the state to do enof torchlighting concerning d attack.

Meanwhile, the governor wen raport wit news people after the attack dis past weekend, he come talk say he go continue to stop fulani bandits from operating inside Benue, say he no go give up.

He come still talk say the state no go lia lia release any land for herdsmen to take dey train their nama nama.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM