+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

House of Reps go torchlight trade of human parts

 

The House of Representatives don decide say dem go torchlight d news wen dey play say illegal trade of human private parts dey go on between Naija and China.

The house take dis decision after all of dem agree on d motion wen Rimamnde Kwewum (PDP-Taraba) sponsor den Olajide Olatubosun (APC-Oyo) come support am for their on Thursday meeting.

Wen Mr Kwewum first dey move d motion, he say about two weeks ago, Chinese authorities seize one cargo ship wen move from Naija with 7,200 gbolas wen don cold for fridge.’

He come say the Chinese General Administration of Customs come raise alarm say some large number of armed groups for Africa dey use d human parts wen dem collect for very bad conditions take dey tidy their yeye paroles.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM