+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Dey Put Eye For Di Beta Side Of Life — Mabel Makun

Na for 2008 nai pipo start to happy say Ayo Makun wey dey sabi comedy don marry Mabel, wey di marriage come even kes to two children.

For long post wey Mabel write for her Instagram nai she take dey confam wetin di husband bin post say their 20 years marriage don kick bucket.

She tok on Wednesday say make no bodi tik say as she quite about di mata she be mumu.

AY wife say as e be now even though say her marriage don enta under bridge, she still gets hope, family members and friends wey dey with her.

Mabel write say pipo wey dey bad mouth her beta stop cus why she decide to kip kwayte na cus of her children.

She even come say make pipo respect AY her foma husband even though say dem dey get problem for marriage.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM