+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Be Iwobi, I Go Curse Pesin Papa and Mama – Sadiq Umar

One of Nigeria football player, Sadiq Umar, don drop hin own update give pipo wey dey bad mouth Super Eagles players as dem loose give Cote d’Ivoire for 2023 AFCON.

Umar nor even play for di AFCON but he say di way pipo take dey blast am for game wey he nor join play, dey bust him head.

Know say before now, Super Eagles midfielder Alex Iwobi don dey get am hot from social media pipo say na him make Nigeria nor win.

Di tin come even make Minster of Sports, Nigeria Football Federation, and Super Eagles say dem nor like the way pipo dey tok against di team for social media.

Naso o, nai Sadiq Umar share post for hin Instagram story say, if anybodi try nonsense with am he go give am back cus him nor be Alex Iwobi.

He say “I no even play you con dey insult me.

“Abeg oo Me, I no be iwobi I go Insult pesin papa with him mama join. Yes I be dat tipical Hausa boy, Abi u see fear for my eyes?”

“You wan put pesin for depression & mental breakdown and you want make life beta for you, e no fit ever beta for una! Vagabonds!!!”

Na di provoke wey di player drop for Instagram today.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM