Pascal Okechukwu, aka Cubana Chief Priest, don go face di judge for di case wey EFCC take give am onto how e yeye Nigeria moni.
Wey Justice Kehinde Ogundare of Federal High Court dey ask weda Cubana chief priest really yeye naira, he say he nor dey guilty.
Economic and Financial Crimes Commission , EFCC, karey teree count charges put for di Instagram socialite head onto how he take dey spray moni for party.
EFCC say wetin Cubana do na against di 2007 act of CBN wey concern how pesin suppose use Nigeria moni pass.
Dem come still say for 13, 2024, inside Eko Hotel, Cubana chief priest just dey spray N500 for two hours and dey yeye am.