+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Play Young Duu Wayo For Di Song Oyinmo – Carter Efe

Oderhohwo Joseph wey dey sing and do skit but everybodi know am as Carter Efe, say hin no play Young Duu wayo for di song wey dem too sing togeda ‘Oyinmo’.

Young Duu first bin dey under singer Portable before he come go join bodi with Carter Efe wey dem two join sing di hit track.

Carter Efe say na a whole 15 million naira nai e put for di song so that e go blow.

But for Young Duu side hin say na only him do Oyinmo song and Carter Efe just dey wan troway am for one side.

For new update inside Spill With Phyna, Carter Efe say na N15 million nai he pour for di project, he come take 60% of do song, give 30% to Young Duu then 10% go meet di producer.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM