+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Wan See You For FEC Meeting If I Nor Call You — Tinubu

Presido Bola Tinubu draw ear warn hin pipo say make dem nor dey karey come di every week Federal Executive Council (FEC) meeting, wey nor bodi tell dem to come.

As President dey tok yesterday, Monday, for di FEC meeting inside presidential villa, hin say he just dey see di way pipo just dey dodge enta di council chamber.

“Last week, I see di way pipo take dey dodge enta, some dey go outside. Pipo dey enta here wey dem nor suppose enta. I nor go take that rubbish.

“I go tell you for here who and who suppose dey inside di meeting.

“Pipo like dem Hadiza Usman, special adviser on policy coordination, Bayo Onanuga, special adviser for information and strategy, Hakeem Muri-Okunola, principal private seketary and Damilotun Aderemi, private seketary.

“Na dem get di right to dey here wey we dey di meeting about di kontri business. Unless I say make you come, beta just dey one lane,” wetin Tinubu warn.

Tinubu come tell George Akume di seketary to di govimet of di federation (SGF), and Folashade Yemi-Esan, head of service of di federation, make dem make sure say di order wey hin give, dem karey am to di fullest.

FEC meeting na every week Monday dem wan dey do am now instead of Wednesday and na Presido dey chair am with hin cabinet members.

[The Cable/SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM