+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

IGP don Scrap SARS

 

IGP Mohammed Adamu

The Inspector-General of Police, Mohammed Adamu don make announcement say dem don quench the police unit, Special Anti Robbery Squad (SARS or FSARS).

The IGP, when dey report directly to the Nigerian presido make the announcement on Sunday afternoon for one press conference wen shele for the Police headquarters.

The police oga come still announce major police changes one na say dem dey form one group wen go dey investigate, the group go include civil society and human right groups, sake of say dem wan torchlight d alleged cases of yeye behavior of the police.

For one side, Barrister Robinson Ariyo wen be rights lawyer don call for sharp sharp assessment of the SARS unit wen the IGP con cancel.

Wen Ariyo dey yarn on Sunday during one telephone conversation, he come talk say the step go helep the force to avoid repeating the same mistakes.

Still on the mata, after the IGP Adamu Mohammed announce the end of SARS, people come burst enter social media dey say make president Muhammadu Buhari talk to Nigerians on top dis same matter.

The announcement show after different #EndSARS protests take place for across the country and some parts of the world.

The Nigerian Police Force come promise say very soon dem go announce one new policing arrangement wen go address some contour wen go dey for the force even as dem don cancel SARS.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM